Proverbs
Wise words and timeless sayings from across Africa, in Pidgin.
Khaki no be leather
No food for lazy man
Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
When breeze blow, fowl yansh go open
Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
Rat when get only one hole go soon enter trap
No loose guard
No condition is permanent
Na wa o!
Na happiness dey make prick stand
Monkey dey work, baboon dey chop
Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
Body no be firewood
Water no get enemy
Use your head
Hustle o
Japa for better life
Shine your eye
Soldier go, soldier come
Monkey no fine, but him mama like am
Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
Life na turn by turn
Half bread better pass none
Patient dog eat fat bone
Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
Na daytime dem dey find black goat
Woman wey never see problem..Na im dey still hold breast run.
na from under tree man de know weda e go fit climb am or not
Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go hear am.
Problem no dey finish
Follow who know road
No be when you don top tree you de know say you fit climb am